#END SARS
Muhammadu Buhari: President Buhari confam say #EndSARS violence kill 69 afta "Lekki toll gate Lagos" shooting 23 October 2020 President Muhammadu Buhari tell one extra-ordinary meeting wit all former Nigerian leaders say a total of 69 pipo na im dem kill inside di katakata across Nigerian. Dem include 51 civilians, 11 police officers and 7 soldiers. Wetin di president confam dey come afta more than 48 hours wen armed sojas open fire wit live bullets at unarmed #EndSARS protesters on Tuesday around 6:45pm for Lekki toll gate for Lagos. Na di next day kasala wey turn heavy violence burst across di West African kontri. Tori be say days of katakata wey start afta protests against police brutality don shake di kontri, wit serious destruction and tiff tiff and even killing join for plenti cities. For di very difficult moment, President Buhari bin do meeting wit all former Nigerian presidents and military heads of state. Di current high level of unemployment na danger for di kontri...
Comments
Post a Comment